Dangote trailer crashes in Jos

This na one lone accident happun dis night, 29th October 2025, around 10:15pm, after British American flyover inside Jos.

Na one Dangote truck wey bin carry cement wey jam wahala. Di truck dey speed, e no know say dem don do diversion for Murtala Muhammad Way because of di ongoing road construction.

As e reach there, di truck lose control, na one drainage for di side wey save am from serious gbese. All di cement pour for ground, and di truck fall.

Our source confirm say nobody die, but di driver and him conductors carry small bruises.

Dis na di second truck accident be dis for that very road, because plenty drivers no know say di road don block temporarily.

More From Author

Why I Joined APC – Daniel Asama

US military designs plan for intervention in Nigeria – light, medium or heavy

One thought on “Dangote trailer crashes in Jos

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *